JUNGLE JUSTICE
Na clear afternoon, sun dy hit ground...
Every face clear,people dy run their parole for market....
Next thing we hear #na thief,na thief, man don dy ground....
Na one voice shout, d rest join am, e spread for market....
Like four guys don corner one man dy couple am....
Bike men don dy bend their tank dey gather fuel for am....
Oga we dey floor don dy shout on top em voice....
No be Steal buh who wan hear dah one everything be like noise.....
Even one woman across the road dy. Shout free am...
Free am buh, dah one cum dy sound like burn am burn am
Before she near scene tire don roll out from nowhere....
Matches no be problem, people wey dey smoke full everywhere ....
Package don set Oga don dy burn self.....
Before you know whatsup everything done done self....
Na leta that day we cum dy hear tape o....
Yawa don cast d whole thing na fuck up o.....
Na den we know say the guy wey dy burn, na the same guy wey dem rob....
Say the guys wey first start to dy couple am na d guys we rob.....
BY: DERRICK OSOKO
#CARTOON
Comments
Post a Comment